John okoro biography
John Inyang Okoro is a
Di highest court go also on di same day deliver judgement on di appeal wey di Labour party and dia presidential candidate, Peter Obi file. One tok-tok pesin to di presidency, Bayo Onanuga wey confam di informate say di APC dey hopeful sau di apex court go affirm say 8. Earlier for 23 October, di Supreme Court bin reserve judgment for di appeal by Atiku Abubakar and di Peoples Democratic Party PDP against di judgment of di presidential election petition court wey affirm di victory of President Bola Tinubu for di presidential election.
Di highest court also reserve judgement for di case of Labour Party and dia presidential candidate, Peter Obi. Na Justice Inyang Okoro wey be one of di most senior judges for di apex court dey chair di panel. Remember say for 6 September, tribunal bin reject Atiku and Obi cases against Tinubu election victory. All di five justices wey dey for di panel rule say di opposition candidates fail to prove say di election bin get K- leg.
Dem say PDP and LP fail to prove dia case of over-voting and voter suppression, dem add say two of dem no provide correct evidence to support dia case for court. Di seven-member panel for di court, wey Justice Inyang Okoro lead announce am on Monday afta Lawyers to di parties bin adopt dia briefs of argument and make final submissions.
Di High court bin also consider arguments from lawyers to parties on di motion wey Atiku file say make dem supply fresh evidence on forged documents. Counsel to Atiku Abubakar, oga Chris Uche, bin beg di court to grant di motion and allow dia appeal grant dia prayers, and make dem disqualify Tinubu. Dem urge di party make dem withdraw dia appeal as e no get prayers for determination.
Counsel for di APM, Machukwu Umeh, bin quickly withdraw im appeal and di respondents no object to di withdrawal. Di court den dismiss di appeal. Di former Vice President don also apply to di Supreme Court to file fresh evidence wey dem get from di Chicago State University against di president.